Wahala as FEDPOLY student don kill himself after he use him school play betting con lose:
One student of The Federal Polytechnic, Ilaro, Ogun State, Samuel Adegoke, on Monday don kill himself after he bin lose his school fees and that of his padi own on top betting.
According to watin Shegzeblog gather the student used hin school fee play bet on Friday con lose.
Adegoke, wey be National Diploma II (ND2) student of Electrical Electronic Engineering, wey dey prepare to write the school first semester examination don kill himself after the kasala happen.
According to informat, he thief hin friend wey bin dey the same room with ham money after he bin get his password, con add the money join hin own school fees, knack the game wella con lose.
Adegoke wey wan double the school before he go pay don later hear word as the school don talk say person wey never pay hin school fees complete, no go fit enter the examination hall.
Due to this gbege Adegoke con carry poison chop before dem go rush ham reach the school clinic he don die.