Chelsea turn chewing stick for Manchester United mouth as they wipe dem 4-1

Manchester United don use awoof Chelsea take qualify for next season champions league after dey wipe them 4-1 for Old Trafford.


No be small flogging as dey pound Chelsea like say dey steal.

Before before almighty Chelsea con be team wey anybody fit beat as dey don shift go 12th position for the Premier League table. 


Chelsea go miss out for all European competition wey dey next season as the position wey dem dey no get head at all. 


Manchester United don join dem Newcastle, Manchester City, Arsenal to go stand with people wey go play Champions League next season. 


No con still forget say Erik Ten Hag be the 5th manager for Manchester United wey go carry the club go champions league for hin first season.